HushPuppi Cries From Jail ? Touching Video Surfaces ! See Photos with Celebrities !

Spread the love

 

video from @stanrerri  instagram   www.rerri.casa

Hushpuppi arrested: See five Nigerian celebs, footballers and politicians wey hangout wit Ramoni Igbalode before im extradition

Di Instagram celebrity wey Dubai police gbab

Wetin we call dis foto,Di Instagram celebrity wey Dubai police gbab

For close to one month now, na hashtag Hushpuppi dey trend for Nigeria social media afta one video wey go viral show as Dubai police take arrest di Nigerian Instagram celebrity wey always dey post fotos of im lavish lifestyles for on top im social media accounts.

Dem arrest Ramon Abbas alias Hushpuppy inside one ‘Fox hunt 2’ operation inside United Arab Emirates on top accuse of crimes wey include money-laundering, cyber fraud, hacking, criminal impersonating, scamming individuals, banking fraud and identity theft.

Some Nigerian celebrities bin show sympathy for am for some of dia comments for social media while others quiet for di mata.

Hushpuppy wey be Instagram big boy dey always roll with celebrities, footballers even politicians. But as dem arrest am, some of dem don comot all di evidence wey link dem together.

Five Nigerian celebrities and Politician wey Hushpuppi bin hangout wit.

  • Senator Dino Melaye

Senator Dino Melaye and Hushpuppi

Wetin we call dis foto,Senator Dino Melaye and Hushpuppi

No be news again say Senator Dino Melaye wey be member of di Peoples Democratic Party and be senator for di eight national assembly bin take foto wit Hushpuppi as di foto bin trend for internet.

Oga Dino for im Instagram handle wia im pose wit Hushpuppi write “my pesin” for di post

For di wake of dis arrest, di All Progressive Congress (APC) wey be di ruling party for Nigeria tell di Economic and Financial Crimes Commission (EFCC) and Nigerian Financial Intelligence Unit (NFIU) to probe top leaders of di Peoples Democratic Party (PDP).

Di party say make security agencies torchlight Atiku Abubakar, di party presidential candidate for 2019, Bukola Saraki, former Nigerian Senate presido, Yakubu Dogara, former speaker of house of representative, and Dino Melaye don take foto wit Hushpuppi for him base for Dubai,

  • WIZKID

Ayodeji Ibrahim Balogun alias Wizkid na Nigerian singer and songwriter wey also hangout wit di Instagram celebrity

Hushpuppi and Nigeria popular Nigerian musician Wizkid

Wetin we call dis foto,Hushpuppi and Nigeria popular Nigerian musician Wizkid

Benjamin Mendy

Benjamin Mendy na footballer wit Man City and e dey French Team.

Hushpuppi and Manchester city footballer @benmendy

Wetin we call dis foto,Hushpuppi and Manchester city footballer @benmendy
  • Inyanya

Nigerian Musician wey become popular afta e win di first season of Project Fame West Africa and im best hit song “Kukere”. He bin chop dinner wit Hushpuppi

Hushpuppi and another Nigerian artist Inyanya

Wetin we call dis foto,Hushpuppi and another Nigerian artist Inyanya
  • Lasisi Elenu

Nigerian social media comedian and skit maker, Lasisi Elenu, na one of di celebrity wey dey always tok beta tins about Hushpuppi.

Nigerian comedian Lasisi Elenu and Hushpuppi

Wetin we call dis foto,Nigerian comedian Lasisi Elenu and Hushpuppi
  • Related Posts

    Dotifi.com – How are tokens generated in banking payments on hardware devices are they stored already

    Spread the love

    Spread the love There are a few reasons why it is important to hang up a mobile call after speaking, even if you did not call: To conserve battery life.…

    Read more

    MORE...

    Leave a Reply

    Your email address will not be published. Required fields are marked *

    LATEST

    A Chrismystery (2025)

    • By abi
    • November 15, 2025
    • 21 views

    In Tenebras: Into the Darkness (2024)

    • By abi
    • November 15, 2025
    • 14 views

    A Woman Scorned (2025)

    • By abi
    • November 15, 2025
    • 15 views

    Nouvelle Vague (2025)

    • By abi
    • November 15, 2025
    • 13 views

    Lefter: The Story of the Ordinarius (2025)

    • By abi
    • November 15, 2025
    • 14 views

    Olamide speaks on the Wizkid, Burna Boy & Davido comparison for the first time

    • By admin
    • November 15, 2025
    • 13 views
    SKITS MOBILE APP SKITS APP
    SKITS APP